Olabisi Onabanjo University

Olabisi Onabanjo University
university
Inception1982 Chenj-am
KontriNaija Chenj-am
Located in the administrative territorial entityOgun State Chenj-am
Memba ofAssociation of African Universities Chenj-am
Official websitehttp://www.oouagoiwoye.edu.ng Chenj-am

Olabisi Onabanjo University, Ago-Iwoye na yunivasiti wey Stet Govment dey kontrol for Ago-Iwoye for Ogun Stet inside Naija. Na for July 7, 1982 dey form di skul as di forma nem na Ogun State University bifor dey kom giv am niu nem Olabisi Onabanjo University for May 29, 2001. Dey chenj di nem bikos of one forma Ogun Stet govno wey bi Olabisi Onabanjo for di tins wey e du to mek di skul dey Ogun Stet. Na 10,291 student don pas komot from di skul an 1,697 postgraduate don also pas komot. Olabisi Onabanjo Yunivasiti get meni kampos. Di nomba one kampos na di one wey Ago-Iwoye wey student dey kol Pamanet Site (PS) an one smol kampos wey Fakolti of Sayens dey bifor dey kari am go di pamanet Site for January 2013. Fakolti of Agrikolsho dey Aiyetoro, Fakolti of Enjiniarin dey Ibogun, kolej of Medisin, Fakolti of Medikal Sayens an famasi dey Shagamu.Studet an pésin wey pass out for di yunifasiti dey kol demsef Great OOUITES. Nius or informashion about di skul dey di skul websait as som magasin an soshial midiya like: OOU Media, OOU Campus Mirror, OOU Press club, OOU update, OOU Gazette, OOH Premium, OOU Parrot, Inside OOU Magazine an OOU Vanguard. Na for smol kampos of OOU "Central for Continuous Education " for pipul wey wan du Diploma an Jupeb bot di main kampos na di ondagraduate.


© MMXXIII Rich X Search. We shall prevail. All rights reserved. Rich X Search